Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 15:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Una must get one law for di pesin wey nor kommit sin from en mind, both for Israel pipol and di strenjas wey dey stay with una.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 15:29
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na di same law una and strenjas wey dey with una go obey forever, bikos all of una na di same for God eye;


“ ‘If strenja wey dey with una won keep di Passova, dem must do am akordin to all di rules and law. Na di same law di strenja and una own pipol go obey.’ ”


Anybody wey kom from Israel or strenja wey chop animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.


“Dis na di law wey una go obey forever. For di tent day for di sevent mont, Israel pipol and di strenjas wey dey stay with dem must fast and dem must nor do any work.


But di savant wey nor know wetin en oga wont and e do tins wey go make dem flog am, dem go flog am small. Pesin wey God give plenty tins to, E go ask plenty tins from am and di ones wey God give plenty, E go ask doubol from dem.”


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Dis na how una go trit anybody wey break God kommand by mistake.


Di priest must do di sakrifice for di pesin wey kommit di sin, den I go forgi-am.


“ ‘But anybody wey kommit sin with en mind, weda dem born am for Israel or na strenja, dat pesin don curse God and dem must kill-am,


Anybody, weda dem born as Israel pesin or strenja wey dey stay with una, must obey dis law.”


Di pipol, rulers, leaders and judge dem stand for di two side for di box and for di Levi priests wey karry God Kovenant Box. Both Israel pipol and doz wey dey der as strenjas dey for di box front. Half of di pipol stand for Mount Gerizim front and di oda half stand for Mount Ebal front, just as God savant Moses kommand dem to do, before dem kollect di blessing.


Wen pesin from anoda land hear di big-big tins wey Yu do for yor pipol,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka