Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 14:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Joshua wey Nun born and Kaleb wey Jefunneh born wey dey among di men wey go shek di land kon tear dia klot, bikos dem dey vex

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 14:6
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.


Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”


And out of di twelf pipol wey Moses send go shek di land, na only Joshua and Kaleb, remain.


from Efraim tribe, e send Hoshea (Joshua) wey Nun born;


from Judah tribe, e send Kaleb wey Jefunneh born;


Den Jakob tear en klot kon wear sak for body and e mourn for en pikin well-well.


Leta, wen Reuben go back to di gutta, e kon si sey Josef nor dey der again! E tear en klot


Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God!


Den Job stand up, tear en klot; barb en hair kon fall face groun.


Eliakim pikin Hilkaya, Shebna and Asaf pikin Joah kon tear dia klot go meet and tell Hezekaya wetin di shief adviser tok.


Den, David orda Joab and en men sey make dem tear dia klot kon wear sak klot take mourn for Abner. King David follow Abner koffin for back wen dem dey go beri am.


Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”


Joshua tear en klot; en and di leaders for Israel fall for groun before di Kovenant Box until evening and dem pak dirty full dia head


But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.


Den all of dem kon tear dia klot! Den dem arrange dia donkey kon go back to di town.


Den di High Priest tear en own klot kon sey, “Why wi dey find more pipol to tok for dis matter?


Wen Banabas and Paul hear about di tin wey di pipol won do, dem shaut, tear dia klot kon run go meet di pipol sey,


Den Moses and Aaron fall face groun for di pipol front.


den dem sey, “Di land wey wi go shek dey good well-well.


Judah men kom meet Joshua for Gilgal and Kaleb wey Jefunneh wey kom from Kenizz born kon tell Joshua sey, “Yu know wetin God tell Moses en savant for Kadesh Barnea about yu and mi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka