Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 14:45 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

45 Amalek and Kanaan pipol for der kon attack and porshu dem go rish Hormah.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 14:45
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God hear Israel pipol prayer kon diliver Kanaan pipol to dem and dem distroy dem and dia towns. So dem kon koll dat place, “Hormah.”


Afta, Judah pipol join Simeon pipol go fight Kanaan pipol for Zefat and dem skata di town finish. Leta, dem kon koll di town, Hormah.


Amor pipol wey dey stay dat aria kom fight and porshu una, just as wiked bee dey do and dem kill una from Seir go rish Hormah.


bikos Amalek and Kanaan pipol dey wait una and dem go kill una well-well. Bikos una don turn from God, E nor go-go with una.”


Ai men kill about thirty-six from dem kon porshu di rest of dem from di town gate go rish di low aria. Di pipol pawa fail dem like ice-blok wey dey melt.


How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?


bikos e sey, “Dem karry dia hand face God throne, so dat God go dey fight Amalek pipol forever.”


Na Amalek pipol dey stay for di sout part for di land; na Hit, Jebus and Amor pipol dey di kountries for hill; Kanaan pipol dey near Mediterranean Sea and along Jordan River.”


plus Hormah, Bor-Ashan, Atak,


Filistia pipol kon gada dia sojas go fight Israel pipol. Wen di fight start, Filistia pipol kon win and kill about 4,000 Israel men for di war.


Den David and en men kon go fight Geshur, Girz and Amalek pipol wey dey stay di land since. David kill dem from di town mout for Shur go rish Egypt.


Yu make sure sey en swod nor mean anytin and Yu nor gri help am for war again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka