Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart.
Di only pesin wey I go allow na Kaleb, Jefunneh pikin wey follow di odas go shek di land and na wetin God wont make e do, na-im e do. I go give en and en shidren-shidren some part for di land wey e bin go look.”
God wey bi awa grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob God, make yor pipol always dey ready to obey Yu forever, so dat Yu go always make dem dey faithful to Yu.