Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 13:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 13:31
8 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na wetin go happen to us? Awa own brodas don make us dey fear, bikos dem sey, ‘Di pipol wey dey di land big well-well pass us; dia kountry dey big and dem fence am rish heaven. Wi still si Anak shidren-shidren for der too.’ ”


Doz wey follow mi kon dey make Israel pipol fear, but I still dey loyal to di Oga my God.


So for dat time, doz pipol nor enter di land wey God promise dem, bikos dem nor bilive am.


Wen dem si di land from Eshkol Valley, dem kon diskorage Israel pipol, so dat dem nor go enter di land wey God don give dem.


Israel pipol, make una listin! Today una won cross Jordan River kon go take doz strong pipol wey get pawa pass una, land. Dem dey stay for towns wey di wall rish di sky!


Den Kaleb tell di pipol sey make dem shut up kon sey, “Wi go attack naw kon take di land; wi dey strong and wi go fit konker di land.”


But Saul ansa David, “Yu nor go fit fight dis Filistia man, bikos e don tey wen dis man don dey fight and yu still small!”


Why una won diskorage Israel pipol make dem nor cross Jordan River go di land wey God don give dem?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka