Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Some yeye pipol wey travel with Israel pipol, get long-trot for meat and dem kon make Israel pipol dey komplain sey: “How wi wish sey wi fit just get some meat chop!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 11:4
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do,


Many strenjas still follow Israel pipol komot from Egypt with all dia sheep, goat and kattle.


For di desert, dem bigin put eye for bad-bad tins kon dey test God patient for dat dry and empty land.


Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”


Wen Israel pipol hear dat part for di law, dem nor kon add all di strenjas for di town join.


Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.


Dem sey, “E for betta sey God kill us for Egypt, bikos wi even dey si food chop for der, but naw, E take us kom dis wildaness won kon kill us with honga!”


non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.


Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?


Make una nor sey, ‘No! E betta make wi go Egypt instead of us to stay dis land, bikos for der, wi go dey free from war and food plenty for der wey wi go chop.’


“I don hear Israel pipol komplain, so go tell dem, ‘Una go chop meat for evening kon chop bread for morning until una beleful, den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God.’ ”


“Make yu tell di pipol make dem klean demsef, bikos dem go get meat to chop tumoro. God don hear una komplain and kry for meat and as una dey sey, ‘Wi dey okay for Egypt before!’ Naw, God go give una meat chop.


Den di pipol kon kry and dem kry well-well till di next day.


And una still make God vex for Taberah, Massah and Kibrot Hattaavah.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka