Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 11:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Na where I go for get meat for all dis pipol, bikos dem dey kry give mi sey, ‘Make yu give us meat make wi chop?’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 11:13
9 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus disciples kon sey, “Where pesin go fit si bread buy wey go rish dis pipol chop, since pipol nor dey stay dis place wey bi wildaness?”


Di disciples ansa, “As dis pipol plenty so, where wi go fit get food wey go rish dem chop for dis wildaness?”


Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”


But Moses ansa God, “I get 600,000, sojas with mi and Yu still dey sey, ‘I go give dem meat for one full mont!’


Even if wi kill all awa animals, dem go rish us chop? Even if wi katch all di fish wey dey di sea, e go rish di pipol?”


but na for one full mont. Una go chop am until meat go kom out from una nose kon make una dey sick, bikos una rijet God wey dey among una kon dey komplain sey, ‘Wi nor for komot from Egypt o-o.’ ”


But Elisha savant sey, “Make I give twenty bread to dis hundred men?” Elisha ansa, “Give am to di pipol make dem chop, bikos God sey, ‘Dem go chop taya and di food go remain.’ ”


One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka