Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Nombas 10:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “Make yu make two trumpet with silva from one hammer. Yu go use am take dey gada di kommunity and to tell dem wen dem won travel.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Nombas 10:2
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!


Make una stop to bring una yuzles ofrins bikos di smell of di incense wey una dey burn, dey make mi vex. I nor wont una new moon festival; una Sabat and where una for dey gada woship mi, bikos sin don spoil all of dem.


Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!


na so too una get one Oga God, one faith, one baptizim,


“Blow di trumpet! Enemies dey rush dey kom attack my pipol like eagle! My pipol don break di kovenant wey I make with dem kon go against my laws.


Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.


Levi pipol wey dey play music na, Asaf, Heman, Jedutun and dia sons and brodas. All of dem wear linen kon stand for di east side for di altar dey play cymbals, lyres and harps. 120 priests wey dey blow trumpet, kon join dem too.


Di money wey dem bring kom God Temple, dem nor use am for silva bowl, wetin dem take dey burn incense, basins, trumpets or anytin wey bi gold or silva.


Yu must blow di trumpet wen yu gada di kommunity, but make yu nor sound alarm.


“Yu go make one lampstand with gold. Na gold wey dem melt yu go take make di bottom, en leg, cups, di small-small seeds and di flowers go bi di same with am.


Yu go use gold wey dem melt take make two tins wey bi like angel wey get plenty feada kon put dem for di two korna for di box kover.


God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.


Make yu blow di trumpet, so dat dem go hear am for Zion wey bi God holy hill. Make evribody fear well-well, bikos God day dey kom.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka