Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mikah 7:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Betta pipol wey dey fear God, don die komot di eart and e nor get anybody wey dey good and honest for dis eart again. Evribody for di eart dey wait to kill each oda; dem dey set trap dey wait dia brodas for road.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mikah 7:2
29 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God, make Yu diliver mi! Bikos all doz wey dey fear and respet Yu, wiked pipol don kill dem finish.


Raitious pipol dey die and nobody undastand or even kare. Betta men dey die, yet nobody dey si di evil wey dey kom.


Wiked men dey stay among my pipol, dem dey wait like pipol wey dey spread net to katch bird or set trap to katch pipol.


Na only evil tins una dey plan to do. Una nor dey fear to kill innocent pipol. Anywhere wey una dey go, na only wahala una dey kause for der


If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem.


“But for naw, mi, wey bi God, dey sey: ‘I dey send enemies wey go katch dis pipol like man wey dey katch fish. Afta, I go send oda pipol wey go katch dem like huntas for mountins, hills and holes for rock.


My papa, si yor klot korna for my hand. Wen I kut am komot, I nor kill yu. So make yu know and undastand sey I nor dey plan to kill or fight against yu.


Na blood and sin bi di foundashon wey una build Jerusalem put.


Awa enemies dey wosh awa movement and naw, wi nor fit waka for di street again. Awa days for dis world don almost finish, bikos wi go soon die.


Dia sojas get pawa well-well and dem nor dey sorry for pesin wen dem won kill-am.


Wiked pipol word dey kill, but raitious pipol word dey save pipol.


My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.


Naw my king, nor let dem kill mi for land wey nor bi God own, bikos sey yu dey look for ant like mi, just as pesin dey look for animal for bush.”


Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.


Bikos God wey get pawa dey vex, en ponishment dey burn di land like fire and E dey distroy di pipol and dem nor dey sorry for each oda.


I don listin to dem well-well, but dem nor dey tok trut. Nobody among dem dey feel bad for di bad tins wey dem do; no one among dem ask sey, ‘Wetin bi di bad tin wey I do?’ Instead, all of dem just dey do wetin dem wont like sey dem bi horse wey dey rush go fight.


Some of una dey kill pipol, bikos of money. Some dey put intrest for di money wey dem borrow dia kountry man and dem dey get plenty gain thru dat one. Dem don forget mi.” Dis na wetin God wey get pawa tok.


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Di town where dem for dey kill pipol, curse dey una head! E bi like dirty pot wey dem nor fit wosh klean. Dem dey remove di meat one-by-one and nor-tin remain inside.


“Una wey bi priest, make una listin! Israel pipol, make una listin well-well! Una wey kom from royal family, make una listin well-well too bikos I dey kom judge una. Una lead di pipol enter trap bikos all of una dey woship juju for Mizpa and for Mount Tabor.


But till naw, my pipol dey tok against mi like sey I bi dia enemy! Doz wey trust mi, una tif dia klot kon let dem look like pipol wey dey kom from war.


but na una even hate good tins kon love wiked tins. Una dey kill my pipol alive kon kut dia flesh from dia bone.


So God sey, “I nor go sorry for anybody for dis land again. Na mi mysef go put all di pipol under dia ruler pawa. Di ruler go distroy di eart and I nor go save pipol from en pawa.”


Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.


Dem go dey fight each oda; Men go oppoz each oda and neighbours go fight against dia neighbour. Yong pipol nor go respet dia senior and foolish pipol go dey curse doz wey dem bin dey respet.”


Di priests dem bi like tif wey hide for bush bikos one attack pesin. Dem dey kill pipol for di road wey dem dey pass go Shekem and dem still dey do many wiked tins!


As e dey tok, di Jew pipol too dey support sey, wetin e tok, na true.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka