Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mikah 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mikah 4:4
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

And for dat day, una go invite una neighbours make dem kom sidan with una under una vine and fig tree, bikos una go get peace.” Dis na wetin Oga God tok.


Judah and Israel pipol get peace thru-out di time wey Solomon dey rule and all di family get dia own grapevines and fig trees.


Wen dem don dey stay dia on land with peace and nobody dey treaten dem again, den dem go forget how dem sofa before wen dem dey sin against mi.


But if una sin against mi, una go die. Mi, wey bi God, don tok.”


Na raitiousness go make una strong. Una go dey save from pipol wey dey opress una and from doz wey dey kause wahala.


Di kountries wey hate dem nor go disturb dem again and wiked animals nor go kill or chop dem again. Dem go stay for peace and nobody go make dem fear again.


den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.” Na mi wey bi God tok all dis tins.


Den God glory go kom out and evribody go si am, bikos God don tok am with en own mout.”


Yu go skata Israel kountry wey nor get who dey protet dem; place where di pipol nor get pawa and dey stay for peace.


“I go make kovenant wey go guide and protet dem. I go distroy all di wiked animals for di land, so dat my sheep go fit stay for peace as dem dey di field and forest.


God, wen wi dey pass thru pain, wi kry, pray and look for Yu, bikos of di way Yu dey ponish us.


I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.


Yu nor go fear yor enemies again and pipol go dey kom beg yu for help.


Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol and di hills go tok about korrect judgement.


Dem go abandon Siria town forever and animals go dey go chop grass for der and nobody go ever drive dem.


“For dat time, di peg wey bin dey der before, go fall for groun, den evritin wey hang on am, go skata.” God, wey dey lead heaven sojas, don tok.


“Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,


My pipol, make una nor fear; make Israel pipol nor fear at-all. I go save una from di far land where una dey as prisonas. Una go kom back to una house kon stay for peace and nobody go make una fear again.


God promise David my papa, ‘Yor pikin wey I go make king afta yu, go build temple for mi.’ And I don choose to build di temple where dem go for woship di Oga wey bi my God.


Yu nor nid to worry about wahala wey go just happen, just as e dey go meet wiked pipol.


and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.


I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again. Mi, wey bi God, don tok.”


God go give Israel pipol to dia enemies until di woman wey dey labor go born. Den en own kountry pipol go kom back to dia land from Babilon.


Israel pipol wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipol, nor go dey dia mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well and nor-tin go make dem fear again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka