Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Matiu 8:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Matiu 8:8
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

E send en words kon heal dem and E take dem komot from deat hand.


Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.


Jesus tosh di man kon sey, “Yes, I wont make yu well!” At wons, di sickness komot from di man body.


E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”


Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.”


“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.


“Den di pikin tell am, ‘Papa, I don sin against heaven and yu. I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.’


I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.” ’


But John won kon stop am sey, “Na yu suppose baptize mi, instead yu kom meet mi make I baptize yu?”


“Make yu take di stik and yu and Aaron yor broda go gada di kommunity, den tok to di rock for dia front and wota go kom out. Like dis yu go bring wota out from rock for di pipol, both for dem and dia animals.”


Oga God, na Yu bi di hope wey poor pipol get. True-true, Yu go hear dia kry kon konfort dem.


I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.


Jesus kon ansa, “I go kom heal am.”


Misef, I bi man wey get oga and I still get sojas wey dey under mi. If I kommand one sey make e ‘Go’, e go-go, if I kommand anoda one sey make e ‘Kom’, e go kom and if I kommand my savant make e ‘Do dis tin’, e go do am.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka