Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Matiu 7:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 “Make una nor give dog tins wey dey holy or trow yor gold give pig, bikos dem go mash am with dia leg, turn face yu, den kon tear yu to pieces.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Matiu 7:6
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make yu nor try to tok sense give foolish pesin, bikos e nor go value am.


Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.


Make una shine una eye, bikos of doz wey dey bihave like dogs and wiked pipol wey dey ponish dia body!


Jesus tell am, “E nor good to give dog di bread wey shidren suppose to chop.”


If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?


Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”


Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda.


Fine woman wey nor get sense, bi like ring wey dem put for pig nose and mout.


den e kon start to sin, dat pesin nor go fit turn from sin kom meet God, since e don kill God Pikin for di sekond time and disgrace am for publik.


I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.


If yu ansa yeye kweshon wey foolish pesin ask, den yu dey foolish, just like di pesin wey ask yu.


Yu wey dey pritend, first remove di big wood wey dey yor eye, den yu go fit si di small dirty for yor broda own.


Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka