16 Yu go know dem with wetin dem dey do. Pipol nor dey gada grape or fig from shuku-shuku.
My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all.
“Good tree dey bear good fruit and bad tree dey bear bad fruit. Na di fruit wey tree bear, naim pipol take dey know di kind tree wey e bi.
So, yu go know di lie-lie profets with wetin dem dey do.”
E bi like dis proverb: ‘Bad tins dey kom out from bad pipol.’ But my hand nor go tosh yu.
Even shidren dey show who dem bi with wetin dem dey do; den yu go fit know if dem good and dey honest.
But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,
If anybody sey, “I get faith and yu get work.” I go sey, “Make yu show mi yor faith wey nor get work and I go show yu my faith thru my work.”