Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Matiu 5:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Matiu 5:9
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.


and make una try to live for peace with evribody.


But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,


I don taya to stay among pipol wey nor like peace.


Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.


But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.


Finally my brodas and sistas, make una use happiness dey do tins as dem suppose bi. Make una take heart, dey greet each oda and live togeda for peace and di God wey get love and peace, go dey with una.


Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.


E get anybody wey won live betta life? Anybody like to get long life?


So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”


Wi dey ripresent Christ, so dat God go tok to una, thru us. Wi dey beg una bikos of Christ sey, “Make una shange kon bi God friend!”


Di next day, Moses si two Israel men dey fight and e won try setol dem. So e tell dem, ‘My pipol, una bi brodas, why una kon dey fight unasef like dis?’


so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.


David go meet dem kon sey, “If una kom like friends kon help mi, den I go make agriment with una! But if una kom sell mi give my enemies wen I nor tosh or wound una, make awa grand-grand papa God si evritin kon judge una.”


Wetin dey make una karry unasef go meet judge wey nor know God?


I dey beg Euodia and Sintike make dem gri togeda inside Christ.


Dem go bi like angels and dem nor go die again. Dem go bi God shidren, bikos dem don wake-up from deat.


Mi wey bi prisona, bikos I dey serve di Oga God; I dey beg una make una dey live una life as God wont.


Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren.


Evritin wey God kreate for dis world, dey wait for God to show en shidren to di world.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka