Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Matiu 4:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Di Holy Spirit take Jesus go inside wildaness make devil for tempt am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Matiu 4:1
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos Jesus sofa and devil tempt am, e don get pawa to save pipol wey devil dey tempt.


Na doz wey God Spirit dey lead, bi God shidren.


Den God Spirit karry mi go inside di kourtyard and God glory full di temple.


I nor go tok too mush naw, bikos di devil wey dey rule dis world, dey kom and e nor get pawa for my body.


So God pawa enter my body with force and as en spirit dey karry mi go. I kon dey vex, but God hand rest for my head with pawa.


Wen dem kom out from di wota, God Spirit karry Filip komot from der and di man nor si am again, but e kon dey happy as e dey go.


Den God Spirit karry mi go up and I kon hear one loud vois dey sey, “Praiz and glory na God own for heaven!”


So, for inside vishon, God karry mi go Israel land kon put mi on-top one high mountin. For my front, I si sometin wey bi like one big town.


But wen I leave yu, God Spirit go karry yu komot sotey I nor go si yu again. If I go tell King Ahab sey I don si yu, den e find and nor si yu, e go just sey make dem kill mi. Dat one nor good, bikos yor savant dey serve God well-well, since wen e bi small pikin.


Den dem tell Elisha, “Fifty strong men dey here with us wey bi yor savants, abeg make yu let dem go find yor oga. May bi God Spirit don karry am go put for one mountin or valley.” But Elisha sey, “No! Make una nor send dem go.”


I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Leta, God Spirit karry mi go meet di odas for Babilon. Den di vishon kon finish


God Spirit kon karry mi go di east gate for di temple. For near di gate, I kon si twenty-five men, plus Jaazanaya, wey Azzur born and Pelataya wey bi Benaya pikin and di two of dem na leaders for di land.


Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.


But temptashon dey kom meet pesin wey get bad tins for mind.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka