E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”
E allow dem travel pass di high place for di land kon chop from di plants wey dey di field. E use honey from di rock and olive oil from strong groun take kare for dem.
For dat time, God tok to Isaya wey bi Amos pikin sey, “Make yu remove di sak wey yu wear and di sandal wey dey yor leg.” So e obey God kon waka naked without sandal for leg too.