Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Matiu 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 “Na yu bi di Mezaya wey wi dey espect or make wi wait for anoda pesin?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Matiu 11:3
38 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”


“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.


Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Many pipol for der bilive am kon sey, “Anytime di pesin wey bi di Christ kom, e go fit do mirakle wey pass wetin dis one dey do so?”


So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


E go dey give mi glory wen e dey tell una di tins wey e dey hear from mi.


Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, “Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us. Make God bless Israel king!”


Jesus kon sey, “Woman, make yu bilive mi, di time dey kom, wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey, nor bi only for dis mountin or for Jerusalem.


“God don bless di king wey dey kom with en name! Make peace dey for heaven and make all di glory bi God own!”


Di pipol wey dey front and di ones wey dey follow am for back kon dey shaut, “Hosanna! God don bless di King wey dey kom with en name.


Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut, “Praiz David Pikin! Di pesin wey kom with God name, God go bless am! Make wi praiz God wey dey heaven!”


“Tell Zion pipol, ‘Si! Una king dey kom meet una, e honbol ensef kon sidan on-top donkey.’ ”


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


I go shake all di nashons and dem go bring all dia propaty kom dis temple. I go kover dis place with my glory.” Oga God don tok.


Doz wey dem save, go-go Mount Zion for Jerusalem kon rule all di mountins for Edom and Oga God go bi dia king!”


But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


Make una bless di pesin wey dey kom with God name. Yes! Wi bless Yu from God house.


‘I don si am, but nor bi naw e go happen; Even doh I hold am, e nor dey near my hand. One star go kom out from Jakob pipol. E go kom out from Israel like septa. E go kill Moab pipol and Seth sons.


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.”


Jesus kon ansa dem, “Make una go tell John wetin una dey hear and si.


Na John bi di pesin wey dem rite for God word about sey: “ ‘Si, I dey send pesin go yor front, make e go prepare di way for yu.’


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka