Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 9:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 So, Pita tell Jesus, “Tisha, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 9:5
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Naw, I know wish one I go choose, bikos I won go dey with Christ and na dat one betta pass.


Dem like make pipol dey greet dem with respet for market and make pipol dey koll dem, ‘Tisha.’


Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


So Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. If yu like, I go build three tent: one for yu, one for Moses and one for Elijah.”


“Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas.


Den Elijah and Moses kon appear for dia front dey tok with Jesus.


(Dem dey fear and dem nor know wetin to tok.)


Den as Moses and Elijah won go, Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” (Pita nor even know wetin e dey tok.)


By dis time, di disciples kon beg am, “Tisha, make yu chop sometin naw.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka