Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 9:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 9:12
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I dey open my back to pipol wey dey beat mi. I nor dey stop dem wen dem dey curse mi; even wen dem dey pul di hair wey dey my face komot.


Pipol go sopraiz wen dem si am, bikos dem bin beat am well-well and e nor bi like human being again.


Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.


God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet and na yu go-go prepare di road for di Oga God,


Wetin e go prish, go make papa setol with dia shidren and shidren go setol with dia papa. If not, I go kom skata and distroy di land.”


One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”


Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


God kon tell mi, “Make yu put dem for di temple pus.” So I take di thirty silva, di money wey dem feel sey dem fit take buy mi kon put am for di temple pus.


My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.


But I dey tell una naw sey, Elijah don kom true-true and dem don do am wetin dem like, just as God tok for en word.”


bikos e dey tish and tell en disciples sey, “Dem go sell Man Pikin give human being. Dem go kill-am and afta three days, e go wake-up again.”


“Si, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go kondemn am and dem go gi-am to di Gentile pipol.


So wen dem gada, dem kon start to ask Jesus Christ, “Oga God! Na naw yu go start to rule Israel?”


Dis Jesus Christ, di good stone wey una trowey, God don make am di main pila wey dey whole di house.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka