Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 7:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di Farisee pipol and di law tishas kon ask Jesus, “Why yor disciples nor dey do akordin to awa tradishon, but instead dem dey chop with dirty hand?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 7:5
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.


Dem hear sey yu dey tish Jew pipol wey dey stay with Gentile pipol, sey make dem trowey Moses Law; make dem nor sekonsaiz dia shidren again and make dem nor follow awa laws again.


I grow among Jew pipol kon know di relijon pass many of my mates for my kountry and I know my grand-grand papa dem tradishons.


take dem follow body make una go do wetin Moses Law tok and make yu pay all di money wey dem spend take shave dia head. Den, evribody go know sey all di story wey dem hear about yu, nor bi true and dem go si sey yu yorsef dey obey di law.


“Why yor disciples nor dey obey awa eldas tradishon? Dem nor dey wosh dia hand before dem chop.”


Doz wey don sekonsaiz, na Abraham bi dia papa and dia faith bi like en own, afta dem sekonsaiz am.


Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin.


Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”


Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own.


Na so una dey use una tradishon wey una dey tish pipol take dey spoil God word. And una still dey do many tins like dis.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka