36 Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere.
Den, Jesus tell am, “Nor tell anybody, but go meet di priest, make e look yu. Afta, go give di ofrin wey Moses kommand to show sey yu don well.”
E kon tell di man make e dey go en house, but e warn am sey, “Make yu nor go inside di village again.”
But Jesus warm dem well-well sey, make dem nor let anybody know wetin happen so, den e kon tell dem make dem give di pikin food chop.
But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
At wons, di man ear open, en tongue luz and e kon start to tok.
Pipol sopraiz well-well dey sey, “Jesus don do evritin well. E even make di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don make dem dey tok.”
As dem dey kom down from di mountin, Jesus kon tell dem make dem nor tell anybody wetin dem si, until Man Pikin go don wake-up from deat.