18 E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye?
Wi get many tins to tok about, but dem nor eazy to esplain, bikos una nor dey gri obey.
So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok.
Why una nor undastand sey I nor dey tok to una about bread? But na make una for guide unasef against wetin di Farisee and Sadusi pipol dey tish!”
So I dey feed una with milk like small pikin and as e bi naw, una neva still fit chop strong food,
Jesus ansa, “Yu bi tisha for Israel, yet yu nor fit undastand dis tins?
Jesus kon ask dem, “Una nor undastand dis parabol? Den how una go take undastand any oda parabol?
Nor bi wetin pesin chop dey make am dirty, but na wetin e tok from en mout.”
Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol.
Bikos nor bi di pesin heart e dey enter, na en belle and e go shit am komot. (Dis one mean sey all food dey klean.)”