4 Den Jesus tell dem, “Na only for profet town, among en own pipol and for en own family na-im di profet nor dey get respet.”
(Bikos Jesus don tok am sey, “Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-town”).
Jesus still sey, “Make I tell una true word, profet nor dey get respet for en home-town.
So dem kon dey vex for am. But Jesus tell dem, “Profet dey get respet for evriwhere, escept for en own village and among en family.”
Even yor own brodas and family dey against yu; dem don join doz wey won kill yu. Make yu nor trust dem, even doh dem dey trit yu well.”
Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”
Jesus kon komot for dat place go en house town with en disciples.