Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 6:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Odas sey, “Na Elijah e bi.” Some kon sey, “E bi like one profet wey dey before.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 6:15
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”


Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey, yu bi Elijah and some still sey, yu bi one for di profets.”


Dem ansa, “Some pipol sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and some dey sey na Jeremaya or one oda profet naim yu bi.”


Make una si, I go send Profet Elijah kom meet una, before God Judgement Day go kom.


Dem ask di man wey blind before sey, “Wetin yu tink about di man wey make yu dey si?” Di man ansa, “Na profet e bi.”


Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”


So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”


Dem kon ask John sey, “Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”


Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?” E kon sey, “No, I nor bi Elijah.” Dem ask am again, “Yu bi di profet?” E ansa, “No o-o!”


Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”


and odas sey Elijah don appear, some still sey one old profet don wake-up.


Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”


Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”


But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka