6 Wen e si Jesus dey kom from far, e run go meet am kon bow down for en front.
Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
Demons dey shaut dey komot from many pipol body, dey sey, “Yu bi God Pikin!” But Jesus warn dem make dem nor tok, bikos dem know sey, naim bi di Mezaya.
Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa!
Di girl kon dey follow mi and Paul for back dey shaut sey, “Dis pipol na God savants o-o, dem dey prish to una about how una go take save.”
Desert go bow before am; en enemies go fall for groun for en front.
Evriday and nite for di beri groun near where mountin dey, e dey shaut, dey use stone dey kut en body.
Den e shaut, “Make yu leave mi, Jesus, yu wey bi God Almighty Pikin! I take God beg yu, nor sofa mi!”