So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”
E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”
Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.
Wen Jesus know wetin dem dey tink for dia mind, e kon sey, “Evry kingdom wey dey fight with ensef go skata and know town or family wey dey fight demsef, go fit stand.