Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 2:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 How en and en men enter God house wen Abiatar bi High Priest kon chop di holy bread wey only priests suppose chop?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 2:26
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Zadok wey bi Ahitub pikin and Ahimelek wey bi Abiatar pikin, na dem bi priests. Na Seraya bi di kourt seketry.


Di seketry, Shemaya wey bi Netanel pikin from Levi tribe kon rite dia names give di king, di ofisas, Priest Zadok, Ahimelek wey bi Abiatar pikin and di leaders among di priests and Levi family. Dem choose each family with di dice wey dem trow for Eleazar and Itama.


David go meet Ahimelek wey bi Nob priest. Ahimelek dey fear wen e meet David, so e kon tell am, “Wetin make only yu dey waka without bodyguard?”


Na Jehoiada pikin, Benaya bi di sojas oga. Na Zadok and Abiatar bi priest.


Di king ask, “Why yu sey make I give Abishag to am? Yu for still ask sey make I gi-am di throne too, since e bi my senior broda and Abiatar di priest and Joab dey en side!”


E follow Joab wey Zeruaya bi en mama and Abiatar wey bi di priest plan and dem kon gri to support am.


Na Sheva bi di kourt seketry, while Zadok and Abiatar na priests


Zadok and Abiatar wey bi priest go dey der. So make yu tell dem evritin wey yu hear from di king palis.


So Zadok and Abiatar karry di Kovenant Box go Jerusalem kon stay der.


Zadok wey bi di priest with Levi pipol, wey karry di Kovenant Box, dey der too. Dem put am for groun, offa sakrifice and dem nor karry am again until all di pipol komot from di town. Even Priest Abiatar dey der too.


Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”


Naw, wen Ahimelek son, Abiatar don run go meet David for Keilah, e karry one efod follow body.


how dem enter God house kon chop di holy bread wey ordinary pipol nor suppose chop, bikos na only priests suppose to chop am?


Jesus ansa dem, “Una neva read wetin David do wen en and en men nor si food chop?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka