Naw, for di matter about pipol wey go wake-up, una neva read for di book wey Moses rite about di bush wey fire dey burn and how God tell Moses, ‘Na Mi bi Abraham, Isaak and Jakob God?’
Jesus kon tell dem, “Una neva read God word wey sey: “ ‘Di stone wey di builders rijet don bikom di pila? Dis na God work and e dey wonderful for awa eye.’
So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”