Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 2:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Wen Jesus hear dis, e tell dem, “Pipol wey well nor nid doctor, but na doz wey nor well nid am. Nor bi good pipol I kom koll, but na sinnas I kom for.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 2:17
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I tell una true word, na so happiness dey for heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipol wey don already dey with God.


Man Pikin kom find and save pipol wey lost before.”


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


Wen di Farisee pipol wey dey der hear wetin Jesus tok, dem kon ask am, “Yu tink sey wisef blind?”


I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”


So, e tell en papa, ‘Si, all dis many years I dey work like slave for yu and e nor get anytime wey I disobey yu, but yu neva give mi even one small goat make I do party with my friends.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.


I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.


But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.


but I first go Damaskus, go tell di pipol wey dey der and den, I kon go meet di pipol wey dey for Jerusalem and Judea. Afta, I go meet Gentile pipol sey, make dem turn from sin kom meet God and make dem do tins wey go show sey, dem don really turn from sin kom meet God.


Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka