Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 14:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Man Pikin go die as dem rite for God word about am, but curse dey di pesin head wey go sell am. E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 14:21
28 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).


“God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.


I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


“True-true, Herod, Pontius Pilate, Israel pipol and doz wey nor bi Jew kon gada for di town against Jesus Christ, yor holy savant wey yu choose


na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.


so dat e go take Apostle Judas, wey kill ensef, place.”


Dis one happen so dat wetin di profets rite for di book go bi true. Den all di disciples kon run leave am.


But if I do am, wetin dem rite for God word about dis matter, nor go happen.”


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.


Pipol go sopraiz wen dem si am, bikos dem bin beat am well-well and e nor bi like human being again.


Make deat distroy my enemies; make di grave swallow dem alive, bikos na wikedness dem dey stay with.


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!”


I dey with una evriday for di temple dey tish, but una nor arrest mi den.” Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word, go bi true.


Jesus ansa, “Na one of una wey dey follow mi chop for di same plate.


As dem dey chop, Jesus take bread, tank God, den divide am give en disciples kon sey, “Make una take and chop, bikos dis na my body.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka