51 Den Jesus ask am, “Wetin yu wont make I do for yu?” Di blind man ansa, “Tisha, make my eye open, make I for fit si again.”
Jesus kon ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
“Wen yu ask for sometin, God go gi-am to yu; wen yu look for sometin, yu go si am and wen yu nok, di door go open for yu.
Dat nite, God appear to Solomon kon tell am, “Make yu tell mi wetin yu wont make I do for yu.”
Make una nor let anytin worry una for mind. Instead, for evry kondishon wey una dey face, make una ask God thru prayer for evritin wey una nid and make una always dey tank am, as una dey pray.
Make una nor bi like dem. Una Papa know wetin una nid before una bigin ask am.
Dem like make pipol dey greet dem with respet for market and make pipol dey koll dem, ‘Tisha.’
Den Jesus koll am, “Mary.” So, Mary turn round face am kon koll am for Hibru language, “Raboni!” (wey mean Tisha).
“Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas.
Bartimaeus trowey di klot wey e take kover body kon jump up go meet Jesus.
Di kommanding offisa whole di boy for hand go one korna kon ask am, “Wetin yu won tell mi?”