Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Mark 10:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 Wen e hear sey na Jesus wey kom from Nazaret dey pass, e kon bigin shaut, “Jesus Christ, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Mark 10:47
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“Make yu leave us o-o, Jesus wey kom from Nazaret! Abi, yu don kom distroy us? I know who yu bi. Yu bi God Pikin wey dey holy.”


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


As Jesus komot for der, two blind men kon follow am dey shaut, “David pikin, make yu sorry for us!”


Dem kon ask am, “Abi na Galilee yu too from kom? If yu look well, yu go si sey know profet go fit kom from Galilee.”


Wen e komot go outside, anoda girl wey bi savant si am kon tell di pipol wey dey der, “Dis man sef dey with Jesus wey kom from Nazaret.”


For der, one Kanaan woman kry kom meet am sey, “Oga God, David Pikin, make yu sorry for mi! My dota nor well, bikos demon dey trobol am!”


Wi hear wen e dey tok sey Jesus Christ wey kom from Nazaret go skata dis place and e go shange all di tradishon wey Moses give us.”


Pilate kon rite for sign-board wey dem nail on-top Jesus cross, wey sey, “dis na Jesus wey kom from Nazaret, wey bi di Jew pipol king.”


Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.


Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?” Filip ansa am, “Make yu kom si.”


Afta, Jesus go Nazaret where e for grow up, e enter di sinagog for Sabat Day as e dey always do and e kon get up make e read.


Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”


Pipol wey dey go for Jesus front and dem wey dey follow am for back kon dey shaut, “Praiz David Pikin! Di pesin wey kom with God name, God go bless am! Make wi praiz God wey dey heaven!”


Two men wey blind sidan for di road korna. Wen dem hear sey Jesus dey pass, dem kon bigin shaut, “David Pikin, make yu sorry for us!”


Di pipol sopraiz well-well kon dey ask, “Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for?”


Wen e rish Nazaret, e kon stay der. Dis one make wetin Profet Jeremaya tok happen sey, “Dem go sey Jesus, na Nazaret e from kom.”


Jesus Christ wey dem born for David and Abraham family, naim story bi dis.


For dat time, one pesin go kom from Jesse family. Yes! One rut go grow kom out from David house.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka