But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”
Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.
God kon make di king sick. Di king get diziz for en skin until di day wey e die. Only en kon dey stay for one house, while en pikin Jotam dey kare, handle di palis and rule di pipol.
E still make one blue stage for di middle. E long rish seven and half fit and na so e wide rish too, but e high rish four and half fit. E klimb di stage kon knee down for all di pipol front, den e raiz en hand go heaven