52 E kon send messenjas go for front and dem enter one village for Samaria go prepare evritin before e go rish der,
Jesus send and tell dem, “Make una nor go Gentile aria go prish and make una nor enter Samaria pipol town,
E fall face groun for Jesus front kon dey tank am. (Di man na from Samaria.)
But one Samaria man wey dey travel for dat road kon rish where di man dey, as e si di man, e sorry for am.
Afta, Jesus choose seventy-two men kon send dem two-by-two go all di town and oda place where e won go leta.
So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”
Dis na wetin dem rite about am, “ ‘I dey send my messenja go yor front, wey go-go prepare yor road for yu.’
“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.
As Jesus dey go Jerusalem, e kon pass di place wey divide Samaria and Galilee.
For am to rish der, e go must pass thru Samaria.
E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin.
Den di woman kon tell Jesus, “How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, ‘Make I give yu wota drink?’ ” (E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)