Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 9:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e bring one small pikin near am

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 9:47
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Naw wi know sey yu know evritin and yu nor nid anybody to ask yu any kweshon. Bikos of dis, wi bilive sey na God send yu kom.”


Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


Jesus know wetin dem dey tink, so e ask dem, “Why una dey tink like dis sef?


Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon ask dem, “Wetin make una dey tink dis kind bad tin for una mind?


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.


My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


E nor nid anybody to tok about am, bikos e know wetin dey inside pipol belle, so e nor fit trust dem.


Wen Jesus hear sey dem dey plan to kill-am, e kon komot from der. Many pipol follow am and e kon heal all of dem wey nor well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka