34 As e still dey tok, one kind kloud surround dem, fear kon katch di disciples, as Moses and Elijah enter di kloud.
Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,
Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi.
Dis message na about Egypt: Si, God dey ride on-top di kloud kom Egypt. Egypt juju fear wen dem si am and di pipol heart kon fail dem.
Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”
Gideon bigin kry, wen e kon know sey na God angel bi dat, den e sey, “My Oga God wey get pawa, I don si yor angel face-to-face!”
Den as Moses and Elijah won go, Pita kon tell Jesus, “Oga God, e good make wi stay here. Make wi build three tent, one for yu, one for Moses and one for Elijah.” (Pita nor even know wetin e dey tok.)
One vois from di kloud kon sey, “Dis na my pikin wey I choose. Make una listin to am!”