28 One week afta Jesus tok all dis tins, e kon take Pita, John and James go on-top one mountin go pray.
Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
As Jesus dey pray alone and en disciples dey near am, e kon ask dem, “Na who pipol dey tok sey I bi?”
Wen dem rish di house, Jesus nor let anybody follow am enter, escept Pita, John and James with di pikin papa and mama.
Afta e don tell dem bye-bye, e kon go pray for one mountin.
For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.
Na di third time wey I dey kom visit una bi dis. If dem sey pesin do bad, two or three pipol must sey, na true, before pipol go bilive am.
So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open,
Wen Jesus si di pipol, e klimb go di mountin and en disciples follow am. Afta e don sidan,
Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening.
But Jesus komot go pray for wildaness, where pipol nor dey.
Jesus komot for der go di mountin side kon sidan der with en disciples.
Bikos, wi nor use awa brain take tell una lie-lie story about Christ pawa and how E go kom back.