Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 9:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Den Jesus ask dem, “But who una tok sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya wey God send.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 9:20
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Some still sey, “Na-im bi di Christ”, but odas sey, “Na lie, Christ nor fit kom from Galilee.


“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”


dey show dem how God word sey Christ must sofa and e go raiz from grave. E tell dem, “Dis Jesus wey I dey tell una about so, naim bi di Christ.”


But Saul still dey prish with pawa. E dey show sey na Jesus Christ bi di Mezaya and di Jew pipol wey dey for Damaskus, nor fit ansa am.


But dis tins wey dem rite so, na make una for bilive sey na Jesus bi di Christ and naim bi Man Pikin and if una bilive am, una go get life thru en name.


Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”


Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”


Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”


E first go find en broda Simon kon tell am, “Wi don si di Mezaya”, (wey mean Christ).


Jesus ask dem again, “But who una sey I bi?” Pita kon ansa, “Yu bi di Mezaya.”


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


As dem dey go, dem kon rish where wota dey, naim di man sey, “Si, wota dey here! Wetin go make mi nor baptize naw?”


kon tell am sey, “If yu know sey na yu bi Christ, make yu tell us.” But Jesus ansa, “If I tell una, una nor go bilive mi


But Jesus kwayet and e nor ansa dem. Den di High Priest kon ask am again, “Na yu bi Christ wey bi God Pikin?”


“Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?” Dem kon ansa, “Na David Pikin.”


If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?


But Jesus kwayet. Den di High Priest kon tell am, “I take God name kommand yu to tell us if yu bi Christ, wey bi God Pikin.”


Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey yu bi Elijah and odas still sey yu bi one old profet wey wake-up from deat.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka