Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 8:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Den Jesus ask dem, “Where una faith dey?” But dem dey fear and sopraiz dey tell each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wota dey obey am!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 8:25
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”


Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ”


If God dey dress flowers wey dey today and pipol go kut am trow for fire tumoro, dat God nor go fit kare for una? Una faith small well-well o-o!


Jesus ansa dem, “Na bikos una faith too small and I tell una true word, ‘If una get faith wey small like mustard seed, una go tell dis mountin, “Make yu move from here go yonda” and e go move and nor-tin go hard una to do.’


kon orda sey make di wota wey dey di sea nor full pass as E kommand am. I dey der wen God lay di eart foundashon.


If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.


Wen Jesus hear wetin e tok, e sopraiz, den e tell di pipol wey dey follow am, “I tell una true word, I neva si anybody wey get dis kind faith for Israel!


Wen evening rish dat day, Jesus kon tell en disciples, “Make wi cross go di oda side for di river.”


Dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!” Jesus get up kon kommand di breeze make e stop and di wota wey rof before, stop and evriwhere kon kwayet.


Dem kon rish Gerasenes aria wey face Galilee.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka