17 Bikos e nor get wetin pipol hide naw, wey God nor go bring out and wetin dey sekret naw, God go bring am out for where lite dey.
“Make una nor fear man, bikos nor-tin wey hide wey nor go kom out and know sekret wey pipol nor go know.
E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sekret naw, wey nor go kom out for open.
For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
E fit hide en wikedness, but evribody go soon si di bad tins wey e dey do.