Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 7:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 7:39
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”


Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin,


Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.


So dem koll di man again kon tell am, “Make yu promise before God sey yu go tok di trut, bikos wi know sey di man na sina.”


Dem kon dey tok among demsef. Some sey, “Jesus na good pesin”, but odas sey, “E dey play pipol wayo.”


Di woman kon tell am, “Oga God, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen.


“Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody,


“Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.


Den, wen one woman from dat town wey bi sina hear sey Jesus dey chop for di Farisee house, e kon bring one fine oil bottol, wey dey send well-well, kom.


Naw, make una bear fruit wey go show sey una don really turn from sin kom meet God, make una nor start to sey, ‘Abraham na awa papa.’ Bikos God fit take dis stones wey dey for groun take make pikin for Abraham!


bikos e go sey, “Make yu kom chop!” But e nor really tok am from en heart, bikos na as e dey tink, na so too e bi.


Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”


so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’


“So, di pesin wey bi last, go bi first and di first, go bi last.”


Pipol wey dey follow Jesus kon sey, “Dis na Jesus, di profet from Nazaret wey dey Galilee.”


E knee down for Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put.


Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin I won tell yu.” Simon kon sey, “Tisha, I dey listin.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka