27 Dis na wetin dem rite about am, “ ‘I dey send my messenja go yor front, wey go-go prepare yor road for yu.’
“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.
And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet and na yu go-go prepare di road for di Oga God,
As Profet Isaya tok for di book wey e rite, “I dey send my messenja for front, go prepare di way for yu.”
John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
Na John bi di pesin wey dem rite for God word about sey: “ ‘Si, I dey send pesin go yor front, make e go prepare di way for yu.’
One vois dey kry sey, Prepare one road for di wildaness for God! Make una klear di road for di desert for awa God!
Wetin una go out go si? Na profet? Yes! I tell una, e even big pass profet.
I tell una true word, among all di pipol wey woman born, nobody big rish John di Baptist, but di pesin wey small pass for God Kingdom, big pass am.”