Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 6:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 6:35
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.”


Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.


God dey good to evribody. E dey sorry for evritin wey E kreate.


Do good and share yor food with poor pipol, den God go bless yu.


Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.


Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.


My Papa go get big honor if una bear plenty fruit, wey go show sey una bi my disciples.


Dis pipol dey always happy to give and blessing dey follow dia shidren.


but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”


E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne.


Den e shaut, “Make yu leave mi, Jesus, yu wey bi God Almighty Pikin! I take God beg yu, nor sofa mi!”


Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”


God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.


So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”


Pipol go dey tink of diasef alone; dey like money; dey boast; dey karry body up; dey tok bad about God; dey disobey dia papa and mama and dem nor dey tank even pipol wey do good for dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka