Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 6:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Curse dey una head, una wey pipol dey tok good tins about, bikos na so dia grand-grand papa dem tok about di fake profets too.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 6:26
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

If una bi friend with di pipol for dis world, dem go love una as dia own pipol. But una nor bi dia friend, bikos I don choose una from di world, naim make dem nor like una.


Una wey dey do bad tins for dis world, una nor know sey to bi dis world friend, mean sey una bi God enemy? So anybody wey gri sey en and dis world na friend, don make ensef God enemy.


“Make yu shine yor eye, bikos lie-lie profets go kom like sheep, but for inside dia heart, dem bi wiked animal wey dey kill.


If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!


Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


Pipol like una, but dem nor like mi, bikos I dey tell dem sey wetin dem dey do nor good.


Bikos dis kind pipol nor dey serve awa Oga God Jesus Christ, but na dia belle dem dey kare for. With dia sweet and wayo mout, dem go praiz and deceive pipol wey nor wise.


Just as dem dey take fire test gold and silva, na so too dem dey test pesin good name.


Curse dey una head, una wey don ova beleful, bikos una go hongry. Curse dey una head, una wey dey laf naw, bikos una go kry well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka