Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 5:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Evribody for der sopraiz well-well. Fear katch dem and dem kon dey wonder dey sey, “Na wonderful tin awa eye si today so o-o!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 5:26
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen di pipol si wetin happen, fear katch dem well-well and dem kon bigin praiz God wey give dis kind pawa to human being.


Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


Afta dem warn Pita and John well-well, di Jew pipol kon leave dem make dem dey go, as dem nor fit ponish dem for di pipol front, bikos dem gada dey praiz God for wetin happen so.


Den all di pipol for Gerasenes and di aria wey near der, kon tell Jesus make e leave dem, bikos dem dey fear well-well. So Jesus and en disciples enter kenu kon komot for der.


Wen Simon si wetin happen, e kon knee down for Jesus front dey sey, “Abeg, nor near mi Oga God, bikos I bi sina.”


At wons, di man get up, karry en bed travel for dia front. Dem sopraiz well-well kon dey praiz God dey sey, “Wi neva si dis kind tin before!”


So dem run komot from di grave with fear and dem kon dey happy as dem dey go tell en disciples.


Di pipol sopraiz well-well kon dey ask, “Dis nor bi David pikin wey wi dey wait for?”


But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


Jerusalem go bring joy, honor and pride for mi and all di nashons for di world go fear wen dem hear about di good tins wey I go do for Jerusalem pipol and how I go make dia town prosper.”


So dem kon dey praiz God bikos of mi.


Fear katch all dia neighbour and for evriwhere for Judea, na di matter dem kon dey tok about.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka