Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 4:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 But I tell una di trut, wimen wey dia husband don die many for Israel for Elijah time, wen God stop rain for three and half years and betta honga kon dey evriwhere.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 4:25
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Elijah na human being like us and e pray with all en mind make rain nor fall. True-true, for three and half years, rain nor fall for dat place.


E get one profet, en name na Elijah and e kom from Tishbe for Gilead. E go tell King Ahab, “As long as di Oga wey bi Israel God (wey I dey serve) dey alive, dew or rain nor go fall for some years, unless I kommand sey, make rain fall.”


Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’


God sey, “I nor dey tink as una dey tink and una ways difren from my own.


For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


E do like dis wen E show us di sekret plan wey E get and di good mind wey E show evribody, thru Christ.


But, my friend, I dey ask, “Who yu tink sey yu bi, wey make yu dey ask God kweshon? Pot wey dem mold fit ask di pesin wey dey mold am sey, ‘Why yu dey mold mi like dis?’ ”


Bikos E tell Moses sey, “I go sorry for who I won sorry for and I go show mesi to who I like show mesi to.”


Dis two men get di pawa to klose di sky, so dat rain nor go fall as dem dey profesai. Dem still get di pawa to turn wota to blood and to kause bad tins to happen for di eart.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka