Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 4:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Jesus tell dem, “I know sey una go kwote proverb for mi sey, ‘Doctor, make yu cure yorsef!’ And una go sey, ‘For here wey bi yor home-town, wi won make yu do wetin wi hear sey yu do for Kapanaum.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 4:23
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus kon komot for dat place go en house town with en disciples.


From der, Jesus komot from Nazaret go Kapanaum wey near di sea, where Zebulun and Naftali pipol dey stay,


So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.


By dis time, di woman don leave en pot wey e take kom draw wota kon run go inside di town go tell pipol sey,


How yu go take tell yor broda sey, ‘Broda, make I remove di dirty wey dey yor eye, but yu nor dey si di wood wey dey yor own eye? Yu wey dey pritend, make yu first komot di wood for yor eye, den yu go si well to fit remove yor broda own.’


Afta, Jesus go Nazaret where e for grow up, e enter di sinagog for Sabat Day as e dey always do and e kon get up make e read.


Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?”


Jesus kon dey waka for Galilee dey tish inside dia sinagog. E prish about God Kingdom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and doz wey nor well.


So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee.


Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.


So Jesus kon go Kapanaum, wey dey Galilee and e bigin tish pipol for Sabat Day.


But Jesus tell am: “Make yu shut up! Yu demon, komot for en body.” Di demon trow di man for groun for dia front kon komot for en body, but di man nor wound.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka