Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 4:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 4:22
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den dem sey, “Dis Jesus sef nor bi Josef pikin, wey wi know en papa and mama? Na how e kon dey tok sey, ‘I kom down from heaven?’ ”


Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.


Yu go no pesin wey wise and dey mature bikos of di undastandin wey e get. As en word sweet rish, na so too e dey give pipol hope.


Make yu prish di trut, so dat pipol nor go get rizin to tok against yu. Den doz wey dey oppoz yu, go shame and dem nor go get word to tok about us.


But dis pipol nor fit stand di wisdom and pawa wey Stefen take dey tok.


Di sojas ansa, “Wi neva si anybody wey tok like dis man before!”


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.


En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.


Bikos betta words wey dem tok well, bi like gold wey dem take dekorate silva.


If yu obey God, yu go always know di rite words to tok. But nobody go trust yu if yu always dey lie.


Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.


Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.


Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,


Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”


Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”


Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka