21 Den Jesus tell dem, “Today, di tins wey dem rite for God word for where I read, don happen, just as una hear am wen I dey read am.”
God don tok before-before thru all en profet sey, di Mezaya go sofa and E don make am happen, thru wetin una do.
Na dis tin make wetin Profet Isaya tok happen, ‘Una go listin well-well, but una nor go undastand. Una go look well-well, but una nor go si anytin,
Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,
Jesus klose di book kon gi-am back to di pesin wey dey hold am, den e go sidan. So evribody wey dey di sinagog kon dey look am.
Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”