42 Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”
Dem ansa am, “Bilive Jesus Christ and yu go save, both yu and all yor family.”
“I tell una true word, anybody wey stand up for publik sey en know mi, mi too go stand up for am for where God angels dey.
“But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’
Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.
I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.
Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?”
Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.
Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”
Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”
Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”
Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today yu go dey with mi for paradise.”